pidgin

/pidgin533

pidgin is a simplified language between groups with no common tongue, using limited vocabulary and grammar from various languages

Una good morning oma and ogbonge people, I dey drop cap for una here because una dey toooo much and una things dey ginger my swagger here die I dey tell you.
Umunnem, that Christmas we dey plan since em don enter house so na only if we close eye open am again air go carry us enter am .
I dey pray say make we dey safe for this period make everything wey go come our side make em stop on the way and every mad belle people wey dey thief us our woods and food when we dey sleep make their village people no see sleep for eye take sleep iseee.

Oma greets by our ezigbo @anyipan
Good morning 🌞 oma people, how things dey go for una side this rushing moment
Hope things don start dey move Siriwele for everyone domot.
Make we go fast fast go put mind into work, make we see wetin we go make out of nothing today , make we just believe in ourselves today say we go move mountain,we go see how it go happen without hitting the lock too much because baba God dey for our side, an there we dey goooo

Ezigbo @anyipan greet 💃
Good morning oma people wey dey sharp how una dey this morning,I hope say body dey gidigbam like Michael power.
Another ogbonge day don break bikonu, you know say person wey never die them no dey bury am, na em make me say make we go hustle today make we see wetin we go use dey charge our battery make we get full current.
I dey pray say as we dey comot for house make wetin we go collect make em dey for road dey wait for us, if we turn for front we go see collect and we turn back we go see collect too na oma day em go be for us all, Amen.

✍️ @ettetor
Good morning 🌄 people we dey sharp how body dey nah,
hope una dey gallant today, na em be wetin dey make me happy nwanne.
Day don finally break, na another precious opportunity to make things happen we don enter so, make we put our mind for whatever we dey do today, surely it most pay.
I dey pray say make chukwu help bless this day for us, make every little thing we go put our hands and mind for make em pay us well well Amen.

Oma greets by @anyipan
Good morning my oga's, how em dey be today for una side na, hope say we all get oma celebrations this weekend nothing smaller than that because na oma oma testimonies I go like to dey hear from everybody .
My people, another working hour don Start hope say you all don dey up make we go hustle for today.
Make I bless una head today say you go make am, anything wey you go place your hand for today go be your own, make you think positive for your heart and your hand go get am like woto-woto.

Writing by our ezigbo @anyipan
Omalicha morning greetings my good people
I dey wave hand for una here because you all dey too much I dey confess.
"how una night dey and this morning I hope everybody up with correct body, perfect".
My good people, I woke from bed with my right hand that mean say na express dey em go be for all of us.
Make you just go put your hand and mind for that little thing you dey do to get food for table, I dey tell you say the blessings and increase way go follow am go blow your head

Ifeanyi greet
Una good morning my ogbonge people
how una dey today
how una night come take go, hope say em dey Siri-were and una come sleep like a new baby.
Today na another day to make am, anything wey go be hold up make em comot for road, anything wey go come pin us make we no get am today make em go faraway.
Make we get too much oil for head wey go lead us to better better place

Ifeanyi greet
Una good morning my people wey dey make me correct, I dey hail una oh from here and I dey thank baba God wey make us carry body put for this omalicha day.
Hope say everybody dey gallant, and we wey dey go work don dey comot for house one by one make we go search for hold body?.
As we don dey go, I dey pray say make chukwu put those good people who go help us get wetin we need today on our way, make everything and every stone come be stepping block to gain wetin we dey search for since, we go make am today Amen.

Ifeanyi greet
Good morning to the oma people wey dey his lungu o. How Una weekend be, hope sey everything go selense for Una side. Make we run this new day as e don start with plenty good vibes.
As we don start this new week make everywhere go jolly jolly for us and make plenty blessing follow us too.

Oma greets for a happy new week by our ezigbo @henryadewole
Correct people good morning from here,
I dey hail una from this side of the world 👋
"how una dey this morning and how una take dey round up this week," hope say say the week carry basket wey full with ogbonge thing come our ways.
Sharp people we don dey round up the year again and I hope say you dey smile dey comot for this year and your pocket dey heavy.
Brothers I wan even tell you say if you never make am this year make you no kill or worry your self soteee you die because we still get many chance before em go finish, a person wey start to walk now go still reach where that person wey dey run reach, make we just focus for baba no go let us go empty

Oma greets by Ifeanyi
Good morning correct ladies and gentle bodies, "how body today nah", hope say everybody dey kamkpee this early morning because na em be the key wey go on our generator today.
My oma people today na another good day to start am from where we stop, na em make yell you say you never go late that place wey dey make you feel you no go make am make you tell am na lie and carry yourself up dust your body down and continue to dey hammer am you go see say nah drinking water em go be for you.
Make we go do the one wey dey our hand, Baba God go do the remaining for us, Amen

Greets by our ezigbo Ifeanyi
💃💃💃
Oma morning greetings Oga kpata kpata and madam of the house wey dey this building,
Wetin dey shele for una side this rushing hour and "how una dey do am this morning,"
hope say we don comot for house make we go hustling site because no dulling moment for our side again, I dey feel una this period, nothing do you.
Sun quick come out today make all hope arise, hope we don dey go for place wey we dey dig ground for better treasure?.
I wan bless una morning say make baba God give us wetin we dey find for em hand, make em no give am person make that person give us, make em come direct to our domot, we no go work our eyes out before we get our daily bread.
Make chukwu bless the day so we go work small and get em rewards double upon double, Amen

Oma greets by Ifeanyi 💃
Good morning my awesome people, how una morning dey go and how una dey take dey push am so.
Hope una dey gallant full everywhere this morning, Odi sharp.
Na another dey wey we don enter sooo, make we dey positive and put our head straight for wetin we dey do make akuba no see us and anything wey we no know no go know us
I dey pray and ask chukwu make em protect us today, make everywhere we go and everything we go do today make we possess am correct make we no lack again, Amen

Oma greets by our ezigbo Ifeanyi
Afa, any sure sporty code for this week? Make I nak my last 5h see how e go be
Like juju
I don dey mumu
Cos you no calling me
You no texting me
I know there's a reason
Una good morning everybody we dey this house
how una dey today, happy new month and happy new week my correct guys.
Hope say una dey gidigbam full ground because na em be the medicine wey dey heal this time sickness so.
My people new week new beginning ,make we go see the good thing wey today go carry give us for we believe say em go good,make we no dull ourselves because na wetin our mind think na em we feel get.
Make we fill our head with better better things and baba no go leave us alone Amen.

Oma greets by Ifeanyi
Good morning 🌞 oma people, I dey wish una happy weekend in advance from this side
"how una dey today", my good people we don dey end this month in just in just a knack of the clock, make we stay safe, make everything wey wan chop our blood make em go faraway from where we dey and as we dey enter Christmas so, I dey pray baba God say make em touch our feet make we Waka fast, make we achieve yapaly wetin we suppose achieve for long time for we no go start early come go last, Amen

Oma greetings by our Oma family and our ezigbo Ifeanyi 🙌🙌
Oma confam people una good morning oh, how una dey take dey push am today and how em dey go nah
Hope una dey gallant full everywhere this morning, Odi sharp.
Na midweek we dey sooo, make we dey positive and put our head straight for wetin we dey do make akuba no see us and anything wey we no know no go know us.
I dey pray and ask chukwu make em protect us today, make everywhere we go and everything we go do today make we possess am correct make we no lack again, Amen

Oma greets by Ifeanyi
Una good morning correct ladies and gentle bodies, "how una take dey do am today", hope say everybody don dey up for we no need dull moment this time, make una put am for mind today say people dey 100% agile dey wait any single opportunity wey go fall and they go carry sleep from your eye come sleep am for you.
I dey anoint una head today say make una own no go fall for another person hand, make wetin olisa plan for you this rushing moment make sleep no come carry us and another man go come take am,
We no go start first and come carry last Amen

Ifeanyi greetings
Correct people good morning oh, I dey hail una from this side of the world 👋
how una dey this morning and how una weekend come go, "hope say una pull mountain down for una too correct die I dey tell you".
Sharp people, another new chapter don open so make we no dull am at-all " make we get up immediately make we go for hustling site, we go put mind into work, make everything come be opportunity for us, I hear say na wetin you mind think na wetin you feel get.
I dey ginger una mind today say make we think big make everything come work in bigger bigger way for us today,Amen.

Oma greetings for an happy new week by our ezigbo Ifeanyi 🙌
My people, my people, Na here we dey go today,
How una dey ? Wetin dey happen for una side, happy Sunday oh, I dey throw away salute for una from here for una dey toooooo much .
As una dey see am today na another blessed day wey we don have make we go make merry for we don work out eye out inside the week na enjoyment lever we dey activate now.
I dey pray and ask baba say wetin we no-no make em no-no us, make the leg we we take enter this free day make we take am come out, make accident and bad news go far far away form us, Amen
Una good morning 🌄 from this side my chairmen and chairladies wey dey here, I dey comot cap 🧢 for una dey too much.
Hope una wake well and una body dey gallant, na em be the correct English word wey I dey hear.
Na weekend we don dey enter so and we don dey look forward for better better enjoyment, make chukwu follow us for back enter this weekend, make em help us for wetin we go do make em prosper, make we work small and get big big gain make our house no go dey dry na em be my prayers for everyone help oh... Iseeee
Una good morning my people,
Wetin dey happen for una side
how una dey this morning
hope say we don dey up for bed abi una still dey sleep eh , nothing do you.
Sun don dey come out, hope arise, hope we don dey go for place wey we dey do day to day push up.
I wan bless una morning say make baba God give us wetin belle go hold today, make we no go today come enter house empty hand, we no go work like elephant come dey eat like ant because baba God dey for heaven em go give us everything we need Amen

Oma greets by Ifeanyi
My pepu, make una gud evening oo,
How una dey do today.